History of IDAN

*IDAN’S HISTORY*
Idan was born in Idanre, Idan write all him Idanwo for street.
Idan no get house but na landlord.

Idan no contest election, dem swear am in.

Idan chewing stick na shovel
.
Only Idan dey use Cocaine as dusting powder.
Idan sow Vawulence, reap peace

Idan no get work but him dey shine.

If Idan borrow your money, naa you dey owe Idan

If Idan comes late, others apologize for coming early

If Idan cut onion, naa onion dey cry.

Idan no dey beg for help, naa help dey beg Idan

If Idan gain admission the school have to pay acceptance fee to Idan

Idan write exam… supervise, mark and grade imsef.

Idan no get wing but him dey fly.
Person wey meet Idan for daytime meet Adanwo.If idan dey cross road, na drivers dey look left and right



All this for u Idan

1 Comment

Leave a Comment